Science don confam am say wen persin wey dey live with HIV dey undetectable, dem not only dey kampe for bodi, dem also no fit pass dis HIV to anoda persin. So, Undetectable = No Fit Transmit (U=U).
Dis be serious big development for di history of HIV. E mean say people wey dey live with HIV wey dey undetectable get no fear of say dem fit pass di virus to people wey dem dey nack. Pipu wey dey live with HIV dey part of the solution to end HIV if dem fit just take dem medicin efri day for make dem dey kampe.
Make una check www.uequalsu.org for more tori. (Link to place to get more tori for English)